SNIPER NO BE DRINK! ROPE NO BE OPTION
Boda chike say em heart don break
E cry sotey tears wey comot his eye fit form river
He tell me say he no fit live without her
His heart weak sotey he con say he won drink sniper
Ah! Boda sniper no be drink I tell am so
She say She no love you again no be say you go kill yourself
Boda Abeg your mama dey wait for you
Mama don enter rain and sun to show you her love
Papa go to bed; no food for stomach for you to chop
No kill yourself Abeg!
Sniper no be drink no taste am
Na for body wey still get life get hope
Sista Ramatu don fail jamb again
Na for the fifth time, e bad no be joke
Ah! Sista say life dey scorn am say make she leave
She come dey tell me about her friends wey hold degrees for hand
God don forget me for back yard
My body dey hot I won go buy sniper
Sista! Sniper no be drink
Nothing dey permanent sista, i know say e no easy
Abeg, save your soul, no loose the air out
Gold go through fire before e come dey useful
Na gold you be, the end go good
Sniper no be drink! No try am abeg
No food to chop, evening don come
Na hunger em come dey battle with for school
Study e no get time to face, ah!
School fee matter dey under my shoe, see I no see
Boda talk say life no funny e won go swing
Eh! Boda, Rope no be option Abeg
This bros dey face hell, i know
Even small garri he no see drink
Boda talk say life don tire him
Oga no give up for this fight
The koko thing wey I know be say, things go better
Bros! Abeg no go near rope, no be option at all.
#NeverGiveUp
#NeverGiveIn
#StayDetermined
#KeepFighting
#SayNoToSuicide
#SayYesToLife
#SuicideIsNotAnOption
©Israel Onoruoiza